Skip to content

Introducing myself

in#introducemyself

NA ME BE THIS (INTRODUCING MYSELF) Hello steemiants, Una well done o, Na me dem dey call Edegwo Festus Obaroakpo a.k.a fexy50. My papa tell me say I be from Delta state wey the slogan be “The big heart”. I get degree for Mathematics, I get anoda degree for Educational Administration, both Na from Delta State University Abraka. Dat one no do me, I come still get sabificate in Project management, sabificate in Human Resource management. Now I come still dey fight for the one wey oyibo dey call second degree, (M.Sc) Business Administration for Ahmadu Bello University Zaria (distance learning) y bcos I too like money, no be my fault, my pile (father) & mile (mother) Na business them dey do, that one come even make me get my own business. C. E. O EFOTEG CONSTRUCTION NIG LTD. I dey sale and supply building materials. And I dey manage building projects too. Am married to my heart rob @odietetessy and I get one beautiful daughter wey go soon join steemit. 20180101_170857.jpg 20180106_181315.jpg HOW I TAKE JOIN STEEMIT Na my first post be this for steemit, but I been Don dey hear of am for my house bcos my younger brother @prechi, the last born of the house @ahmprisca, my elder sister @dinah4sure and my wify @odietetessy dey sing steemit like the chorus of west life coast to coast. Make I for no carry last base on delta pikin wey I be na me self carry my two left leg go the Steemit reach out seminar wey @prechi organise. After the seminar Na em I tell my self say I no go fit dey inside river make soap dey enter my eye. I sign up sharperly so that me self go still follow them explore and reach out to many oda people just the way @tojukaka, @ewuoso and @prechi dey do and at the end the aim Na to give back to the community.

IMG_20160623_085910.jpg MAKE I DESCRIBE MY SELF SMALL I no too tall, I no too short, oyibo call am average, I fair small and I be fine boy (ask my wife @odietetessy) I dey cool, calm and collected. I dey like play football, table tennis and I dey like make good friends, I love good musics, I dey travel well well, I speak Hausa fluently, Yoruba small, igbo small, and I dey like give and help people wey no too get oyibo call dem less privileged. I like politics die, I been Don serve for different capacity wen I been dey university, the last one Na Director of information (S. U. G) Delsu. I get intention for the Red chambers someday. IMG_20150610_111524_edit.jpg IN CONCLUSION Steemit Na the best place to be, I hope all steemians go accept me the way I be, I believe I go catch fun here, make plenty good friends, and learn new things. one love to everyone here. Thank you, Merci, asante Sana,obrigado. Cc: @prechi,@dinah4sure,@ahmprisca,@odietetessy.

·in#introducemyself·by
5
Sort:
  • dinah4sure profile picture

    Welcome to steemit

    $0.00
    • fexy50 profile picture

      Thanks so much, it's a privilege been here

      $0.00
    • winstonomeruah profile picture

      Welcome to steemit bro

      $0.00
      • fexy50 profile picture

        Thanks man

        $0.00
      • steem-network profile picture

        $0.00